By Newspot Staff Writer 🖋️
How una dey, my correct people! Na your Newspot Nija Guy o dey here again with dis hot gist wey go blow your mind!🔥
Dem don bring one new proposal wey dem dey call DOGE Dividend—na one investor wey him name be James Fishback dey push am. But make I talk am straight—na rich people go enjoy this one o! 😮
If your salary never reach $40,000 per year, my brother/sister, forget am, you no go see shishi. Fishback dey talk say 20% of di government savings suppose go back to people wey dey really pay tax. But na only people wey dey pay pass wetin dem dey collect go qualify. You see am? Na coded awoof for the rich.
As if that one no do, na Elon Musk and even President Trump don jump support for this plan. But people wey sabi dey call am “rich-man rebate in disguise.”
Economists sef don warn say if dem share this kind money now, e fit still cause serious inflation ( I no know wetin be dat one for broken English o make una no vex), like wetin we see during COVID wahala.
Dem dey call am rebate, but na real gift for the big men dem. Experts dey talk say make we no carry our hope put for this kin miracle money. Instead, make we dey save, dey invest, and dey clear our debt small-small.
If you wan sabi more, waka go NewspotNG.com.
Na me be your padi for Newspot Nija—we go yan again soon! ✌🏽









